(Go: >> BACK << -|- >> HOME <<)

Jump to content

Teni: Difrens wey dey for rivishon-dem

From Wikipedia
Content deleted Content added
No edit summary
No edit summary
 
Line 1: Line 1:
{{Databox}}
'''Teniola Apata''' (Dem [[bon]] 23 December 1992) wey pipo sabi wel wel as '''Teni The Entertainer''' na [[Naija]] singa an song raita.
'''Teniola Apata''' (Dem [[bon]] 23 December 1992) wey pipo sabi wel wel as '''Teni The Entertainer''' na [[Naija]] singa an song raita.



Rivishon wey hapun last for 20:28, 10 May 2024

Teni
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejTeniola Apata Chenj-am
Orijina nemTeniola Apata Chenj-am
Fest nemTeniola Chenj-am
Famili nemApata Chenj-am
AliasTeni Chenj-am
Wen dem bon am23 December 1993 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos State Chenj-am
Broda an sistaNiniola Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumusician, singa Chenj-am
Wie e go skulApata Memorial High School Chenj-am
Wen e stat wok2016 Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Notable workUyo Meyo Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Teniola Apata (Dem bon 23 December 1992) wey pipo sabi wel wel as Teni The Entertainer na Naija singa an song raita.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Teni on 23 December 1992 inside Legos Stat. One Naija singa wey e nem na Niniola bi sista to Teni. E go Apata Memorial High Skul, kon leta go Amerika Intakontineta Univasiti to get im Digre in Bizines Hadimini strashon.

Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

2016-2019:fargin, Askamaya an Odas Rekordin

Teni du im fest song Amen wen e dey onda Shizzi Magic Fingers rekods. Teni leta komot for di rekod lebel kom go sahin kontrat wit Dr Dolor Entertainment in 2017. Pipo sabi Teni wel wen e sing fargin in September 2017. Pipul kon sabi am fo di wod wen e du Askamaya,Case an Uyo Meyo. Askamaya enta nomba 15 for MTV Base's year-end for di Top 20 Naija song wey hot pas for 2018.

For 20 February 2019, Teni nem dey for You Tube Muzik as singa wey jus kom an wey pipul like pas. For May 3 2019, Teni rilis vidio for Sugar Mummy song. For 14 June 2019, e rilis niu song wey bi Power Rangers.

2019-2020:Billionaire E.P An Quarantine Playlist

Teni rilis E.P Billionaire on 11 October 2019. Di E.P Billionaire get 6 trak an na onli Teni du am. Na Jaysynths Beatz an Pleez bi di produsa wey wok for di E.P. Inside April 2020, Teni wit DJ Neptune tok say dem wan rilis E.P, wey dey kol Quarantine. Di EP get 4 trak wey produsa like Tempoe, P.Prime an Dëra wok on top am.

2021-Present:Wondaland an Little (Love I Love) For 2 February 2021, Teni rilis di nem an day wey im niu habom go kom out. Na for im Instagram e tok di nem of di album wey bi Wondaland.

Di produsa wey folo am wok for di album na Pheelz, Damayo, Tempoe, P. Prime, Millamix, Krizbeatz, an Ozedikus. Di album dey fo difiren plaz lik Apple Music, Amazon Music, Spotify, Deezer an Goggle play.

For 2022, Teni rilis niu song wey bi Little (Love I Love), Na for United Kingdom e tek du di vidio.

Som Oda Kontrat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fo March 2019, Teni sahin kontrat wit Tom Tom, wey Cadbury Naija dey du. On October 6 2020, Pm Nius tok say Teni don sahin Kontrat wit Globacom Naija.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]