Karim David Adeyemi: Difrens wey dey for rivishon-dem

From Wikipedia
Content deleted Content added
Tag: Reverted
Line 10: Line 10:

Wen Borussia Dortmund play di Round-16 Shampion Ligi game with Chelsea on 15 February 2023, Adeyemi score di onli goal wey hapun inside di game. Wen Borussia Dortmund play Bayern Munich on 30 March 2024, Adeyemi score di opunin goal for di two goal wey e klub tek win dat game dat day.

==How e tek start life==
Na for Munich wey de Germany dem bon Karim Adeyemi. E papa kom from Nigeria but e mama na from Romania.

==Di way e dey run==
==Di way e dey run==

Chenj wey hapun for 07:52, 6 May 2024

Karim David Adeyemi (dey bon am 18 January 2002) na German futbola wey dey play for one German klub [[Borussia Dortmund an German nashonal tim. Na front Adeyemi dey play.

How e tek play futbol

  • Red Bull Salzburg

Adeyemi play futbol wey e still dey young for TSV Forstenried. Wen Adeyemi don rish Eight, e join Bayern Munich. Bayern Munich na one klub wey dey play Bundesliga in Germany. Di date wen e join di klub na 2010. Bikos of one mata like dat abaut e kontrat, Adeyemi nid to komot from Bayern Munich to SpVgg Unterhaching in 2012. Afta wey Adeyemi don dey shine for difren levu of di youth dipamet, e play e fest game for SpVgg Unterhaching Onda-19 tim in Ma rch 2018. Wen 2018-2019 futbol sisin wan start, Adeyemi sahin three-year kontrat for Austrian klub FC Red Bull Salzburg. Di klub kom kari am go dia smol oda klub FC Liefering for dat sisin. Adeyemi play e fest 2. Liga game on 1 September 2018 for di game wey FC Liefering play with Austria Lustenau. E tim FC Liefering lost di game 1:0. Adeyemi play start an finish di game dat day. For 1 December 2020, Adeyemi score e fest Shampion Ligi goal. Na inside di game wey e klub play with Locomotiv Moscow dorin di 2020-2021 Shampion Ligi sisin. Di game finish 3:1.

  • Borussia Dortmund

Adeyemi join Borussia di Bundesliga klub Borussia Dortmund on di 10 May 2022. E sahin sey e go play for di klub till 2027. On 5 October 2022. Adeyemi score e fest Shampion Ligi goal for Borussia Dortmund wen dem play Sevilla. Borussia Dortmund win dis haway game 4:1.

Wen Borussia Dortmund play di Round-16 Shampion Ligi game with Chelsea on 15 February 2023, Adeyemi score di onli goal wey hapun inside di game. Wen Borussia Dortmund play Bayern Munich on 30 March 2024, Adeyemi score di opunin goal for di two goal wey e klub tek win dat game dat day.

How e tek start life

Na for Munich wey de Germany dem bon Karim Adeyemi. E papa kom from Nigeria but e mama na from Romania.

Di way e dey run

For February 2023, na Adeyemi bi di playa wey sabi run pass for di hole Bundesliga. E speed na 36.65 km/h (22.7 mph).