Emmanuel Iwuanyanwu: Difrens wey dey for rivishon-dem

From Wikipedia
Content deleted Content added
Created page with "'''Emmanuel Chukwuemeka Iwuanyanwu''' (Dem bon am on September 4,1942) na Naija politishan an biznesman, som dey ci am as one of Igbo pipu wey get moni pas for Naija. ==Hau e tek stat life== Dem bon Chief Emmanuel Iwuanyanwu on Friday September 4, 1942 to Pa Bernard Iwuanyanwu an Madam Hulder Iwuanyanwu of Umuohii Atta insaid Ikeduru Lokal Govmet Aria of Imo Stet of Nigeria. Im granpapa, Iwuanyanwu, na kommanda wey kari lokal solja go faight. Dem bon a..."
 
No edit summary
 
Line 1: Line 1:
{{Databox}}
'''Emmanuel Chukwuemeka Iwuanyanwu''' (Dem [[bon]] am on September 4,1942) na Naija politishan an biznesman, som dey ci am as one of Igbo pipu wey get moni pas for [[Naija]].
'''Emmanuel Chukwuemeka Iwuanyanwu''' (Dem [[bon]] am on September 4,1942) na Naija politishan an biznesman, som dey ci am as one of Igbo pipu wey get moni pas for [[Naija]].



Rivishon wey hapun last for 19:32, 10 May 2024

Emmanuel Iwuanyanwu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemEmmanuel Chenj-am
Wen dem bon am4 September 1942 Chenj-am
Ples wey dem bon amImo State, Ikeduru Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo pipul Chenj-am
Wok wey e dey dubusinessperson, politician Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Nigeria Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
E pipul Chenj-am
Awod wey e koletAcademic honors and performance Chenj-am

Emmanuel Chukwuemeka Iwuanyanwu (Dem bon am on September 4,1942) na Naija politishan an biznesman, som dey ci am as one of Igbo pipu wey get moni pas for Naija.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Chief Emmanuel Iwuanyanwu on Friday September 4, 1942 to Pa Bernard Iwuanyanwu an Madam Hulder Iwuanyanwu of Umuohii Atta insaid Ikeduru Lokal Govmet Aria of Imo Stet of Nigeria. Im granpapa, Iwuanyanwu, na kommanda wey kari lokal solja go faight. Dem bon am insaid famili wey no tu dey du shakara bikos dem get moni. Chief Iwuanyanwu na politishan, biznes man an pesin wey dey lik hep pipu wey no get plenti pipu sabi am as dat kain pesin tu. E go St Patrick's Skul, Nkpokwu (wey leta chenj to Rukpokwu), Port Harcourt, for im standard one rish four, fom 1948 rish 1952. For im standard five an six, dem transfa go Holy Trinity Chorch, Umuapara (wey leta bi Rumuapara, nau e dey Obiakpo Lokal Govmet Aria ,Rivers Stet). Dis one na fom 1953 rish 1954. Fom 1955 to 1959, e go New Bethel College, Onitsha, Anambra State. In 1960, Emmanuel Iwuanyanwu, wit some oda pipu wey sabi buk wel go Federal School of Science, Lagos, wia e tek stodi Pure an applied Mathematics, Physics an Chemistry.

Edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1963, e get admission to go stodi for Universiti of Nigeria, Nsukka wia e tek len Civil Engineering. Bikos of di kain way e tek sabi buks, dem giv Iwuanyanwu German Academik Exchange Scholarship wey bi sey na dem go pay for food,ticket wey e go uze fly go dia, wey Federal Repoblik of Germany sponsor. German Academik Exchange Scholarship wey bi sey na dem go pay for food,ticket wey e go uze fly go dia, wey Federal Repoblik of Germany sponsor.

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Chief Iwuanyanwu mari waif wey dem don dey togeda sins 40 years, Lady Eudora Nnenna Ozinyereaku Iwuanyanwu, wey don bon three sons and five daughters for am, e kpai on August 28, 2011, wen e dey 63 years. Chief Emmanuel Iwuanyanwu mari anoda waif wey bi Frances Chinonyerem (nee Enwerem) on September 14, 2013.

Wetin dem rait abaut am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Two volume of hau Emmanuel Iwuanyanwu laif wey Jeff Unaegbu, Sam Chukwu an Chinedu Nwafor rait abaut am in 2022. Dem giv am copi of di buk wen e dey du im 80th Birthday on September 4 2022.

Nashonal honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akademik Honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

Doctor of Laws, Shaw University, Raleigh, North Carolina;

Doctor of Science, University of Jos, 1989;

Doctor of Science, University of Calabar, 1990.